Hot topics close

Liverpool vs Tottenham highlights: Luis Diaz score afta Son Heung-min goal to make am 1-1 draw for Anfield

Liverpool vs Tottenham highlights Luis Diaz score afta Son Heungmin goal to make am 11 draw for Anfield
Dis match na must win for Liverpool if dem wan go top of table
7 May 2022, 16:04 WAT

New Informate 52 minutes wey don pass

Diaz celebrate goal

Wia dis foto come from,

Liverpool draw 1-1 wit Tottenham for Anfield as dem drop two points for di battle of who go win di 2021/2022 Premier League title dis season.

Di mata be like two Horse race as Liverpool and Manchester City no dey allow each oda breath.

As e be Liverpool top on goal difference but Manchester City dey face Newcastle at home on Sunday.

While Tottenham move to within just a point of Arsenal, who go welcome Leeds to di Emirates on Sunday.

Live updates as e happun

5 mins: Game don start.

Liverpool 0-0 Tottenham

Tottenham dey attack di Kop end but na long ball dem send straight through to Alisson.

Liverpool first hold of possession dey dangerous as Luis Diaz cut am inside and Trent Alexander-Arnold almost tee up Sadio Mane.

Sadio Mane run towards di box and e shoot from distance. E connect well enough but e go straight to Hugo Lloris.

5 mins: Liverpool don settle early and dem dey backed by di loud crowd for Anfield. Spurs dey get to defend.

7 mins: Emerson Royal do well as e stop Sadio Mane cross, wit di help of Son Heung-min.

Liverpool press hard, almost win am back, but Spurs break down di right. dem paly am to Alisson wey get to stop Son from touching am before di flag go up for offside.

9 mins: Spurs be like threat some few moments ago but dem no fit really comot di ball from Liverpool hand right now.

10 mins: Harry Kane do well as e move past a few challenges on di left and take on Trent Alexander-Arnold. Di Liverpool full-back keep up and tackle am near di byline, before e bring am out coolly.

11 mins: Jordan Henderson clear one ball wey Sadio Mane pass give Mohamed Salah but im shot dey deflected out go corner.

12 mins: Harry Kane get space for di box afta a neat, floated pass from Pierre-Emile Hojbjerg but im shot dey blocked by Jordan Henderson.

14 mins: Brief break as Dejan Kulusevski need treatment afta one challenge with Thiago. E look like say e go dey OK to carry on.

16 mins: Tottenham dey get more of di ball now and e be like say dem don dey more comfortable now.

18 mins: Great work by Emerson Royal to win one throw-in off Sadio Mane.

19 mins: Trent Alexander-Arnold whip in one dangerous ball wit power. Emerson Royal head am and Thiago no fit control am on di edge of di box. Fabinho den press di defence immediately but dem play am away.

21 mins: Mo Salah chest one long ball down di box. E link up with Andy Robertson and Ben Davies poke am behind for corner before Salah fit shoot am. Davies too get luck - di referee give am goal kick.

22 mins: Thiago win am back for Liverpool and e find Luis Diaz. E give am to Jordan Henderson wey two players surround but e manage to win a corner afta dem tackle am.

23 mins: Virgil van Dijk beat Eric Dier for air and head am towards goal. E go wide for di end.

24 mins: Trent Alexander-Arnold pass dey stopped on di edge of di box but Luis Diaz win am back immediately from Ben Davies. E come back across to Alexander-Arnold but e fire am over di bar.

26 mins: Harry Kane first touch na good one and e spin past Fabinho. Di Brazilian try to make up for am wit a sliding challenge but e clip di ankles of Kane.

27 mins: Luis Diaz tackle some challenge down di left. E cut inside and shoot one shot but e dey blocked by Eric Dier.

29 mins: Ryan Sessegnon try to stop one ball from reaching Jordan Henderson for di box and end up heading am towards im own goal. Mohamed Salah dey close in as Hugo Lloris get to make a diving save to put am away.

30 mins: Spurs win corner on di left but Trent Alexander-Arnold dey able to hook am away.

31 mins: Mohamed Salah dey double-teamed by Ben Davies and Rodrigo Bentancur but Bentancur later come in somehow to concede free-kick on di touchline. Salah no get anywhere to go but now Trent Alexander-Arnold fit whip am in...

33 mins: Pierre-Emile Hojbjerg clearance dem fall to Thiago. E come back to Andy Robertson and e head am back across goal dangerously, e force Hugo Lloris to come out.

Cristian Romero come give am away as Sadio Mane almost pounce on am inside di box.

35 mins: Emerson Royal knock am past Andy Robertson and ball hit am for face. Free-kick to Spurs.

37 mins: Cristian Romero play anoda risky pass for di back but e dey backed up quickly by Ben Davies, wey slide am in to deny Mohamed Salah.

38 mins: Pierre-Emile Hojbjerg come in late on Thiago afta one short pass from Rodrigo Bentancur and Liverpool collect free-kick inside Spurs half.

39 mins: Eric Dier nod am behind with Ibrahima Konate behind too.

Trent Alexander-Arnold run over to take di corner... And Virgil van Dijk smash am against di crossbar.

40 mins: Thiago pass am give Sadio Mane. E spin am to Cristian Romero and e land just for di edge of di box.

41 mins: Mohamed Salah tee up Trent Alexander-Arnold but e hit am for wall. Thiago shoot shot but e dey blocked, Sadio Mane no fit control one pass across di six-yard area and Liverpool dey straight back at Spurs down di left to win a corner.

42 mins: Jordan Henderson cross dey blocked. Dejan Kulusevski try to break but three players come on am immediately. Andy Robertson find Luis Diaz and e force Hugo Lloris to make save.

43 mins: Spurs break down di middle and Pierre-Emile Højbjerg get space. E drill am well towards di bottom left corner and e bounce off di outside of di post.

Liverpool 0-0 Tottenham

Sadio Mane wit di ball

Wia dis foto come from,

SECOND HALF

46 mins: Liverpool 0-0 Tottenham

Game don start.

47 mins: Jordan Henderson give am to Mohamed Salah just inside di box. He try to give am to im team-mate but e go straight to Eric Dier.

Cristian Romero come give am away again under Liverpool press but Sadio Mane pass for Henderson dey behind.

49 mins: Spurs give am away under pressure again but Mohamed Salah ball into di box dey poor.

50 mins: E dey close!

Thiago pass am over to Jordan Henderson. E knock am down for someone for di middle but e dey hooked away fast-fast. Di rebound fall for Trent Alexander-Arnold and e dey deflected behind go corner.

52 mins: Jordan Henderson and Thiago both slide in and e be like dem foul Harry Kane in di process. Free-kick to Spurs for di middle.

54 mins: Emerson Royal cross dey deflected behind by Andy Robertson. From di corner wey e result to, e dey half-cleared to Ryan Sessegnon but wen e chip am back in, Harry Kane dey offside and e know am. Liverpool den go long straight away and Ben Davies wrestles Mohamed Salah to di floor.

Anoda dangerous break by Spurs with Son Heung-min but enough players dey around am to block di shot inside di box.

55 mins: Eric Dier switch am over to di left for Ryan Sessegnon. Trent Alexander-Arnold get to come across to block.

Son scores

Wia dis foto come from,

56 mins: GOAL!

Dem play am over di top for Harry Kane from Hugo Lloris. None of Liverpool defenders challenge am and e lay am off to Ryan Sessegnon on di left.

He get so much space and time and e slide am across di middle for Son Heung-min to help am into an empty net from close range.

59 mins: Andy Robertson take free-kick for Liverpool as dem look to respond immediately. E find Ibrahima Konate but e head am comfortably over di bar.

60 mins: Ryan Sessegnon no fit get on di end of Dejan Kulusevski cross before Alisson get to be alert to gada di shot from di edge of di box.

61 mins: Trent Alexander-Arnold curl am in from di right and Emerson Royal take no chances, e head am behind.

Mo Salah dey wit ball

Wia dis foto come from,

65 mins: SUBSTITUTUONS

Jurgen Klopp don make im move.

Jordan Henderson and Andy Robertson dey off. Diogo Jota and Kostas Tsimikas come on.

67 mins:. Liverpool dey switch play, dem dey put crosses in and corners but Spurs dey block am, head am away and clear everytin.

68 mins: YELLOW CARD

Kostas Tsimikas pull back Dejan Kulusevski as e try to get away on di right. E collect card.

70 mins: Na Liverpool turn to break now. Sadio Mane ping am over to Mohamed Salah. E cut inside of Ryan Sessegnon and e dey pulled back. Anoda card.

72 mins: Kostas Tsimikas get a free header in for di Spurs box but e head am straight down to Son Heung-min despite several players dey wait for di six-yard area. Trent Alexander-Arnold come try to apply pressure but na foul.

73 mins: Thiago find Mohamed Salah. E shift am to im left and cut inside to di box. E dey about to shoot but Ben Davies block am.

Diaz scores

Wia dis foto come from,

74 mins: GOAL!

Liverpool 1-1 Tottenham

Luis Diaz (74 mins)

E shoot from long range and na heavy deflection off Rodrigo Bentancur before e enta di bottom corner.

Hugo Lloris no fit touch am e just dey look am.

77 mins: Liverpool dey hungry for a second goal. Mohamed Salah and Sadio Mane get few touches inside di box but dem no fit shoot off. Di attack continue though.

79 mins: Fabinho curl am in towards di back post. Emerson Royal no know if anyone dey behind am and put am out for a corner.

E dey half-cleared, volleyed back in by Thiago but Sadio Mane dey penalised for a push in di box.

81 mins: Son Heung-min take a few minutes to collect some treatment afta a heavy landing but e dey good to go.

Ibrahima Konate concede corner for Liverpool as Harry Winks dey get ready to come on.

SUBSITUTION

Antonio Conte make IM move now. Davinson Sanchez dey on for Ryan Sessegnon.

83 mins: Liverpool get defend a few corners near post but Tottenham retain possession.

Eventually e come through to Alisson, e give am to Trent Alexander-Arnold and di crowd encourage am.

Luis Diaz pull am back to Diogo Jota... Cristian Romero tackle am.

85 mins: Dejan Kulusevski dey caught on di edge of di Spurs box and win a free-kick so Antonio Conte fit make im change.

Harry Winks enta as Kulusevski comot.

86 mins: Anoda Liverpool corner. E dey cleared.

Five minutes or so to see how e go end.

88 mins: Trent Alexander-Arnold latest cross dey cleared and Spurs break. E come to Pierre-Emile Hojbjerg but e blast am well over di bar from close range.

More changes now too. Naby Keita and Steven Bergwijn dey come on. Fabinho and Son Heung-min dey off.

89 mins: Thiago see di pass and Trent Alexander-Arnold dey onside but e overhits am.

90+2 mins: Steven Bergwijn try to get di better of Virgil van Dijk but di Liverpool centre-back block am off am and call Alisson to collect.

90+3 mins: Naby Keita boot dey high as e catch Harry Kane.

Free-kick to Spurs for di Liverpool half.

90+4 mins: Harry Winks chip am into di middle and Pierre-Emile Højbjerg dey completely free. E try to head am back into di six-yard area for Harry Kane instead of going for goal and Virgil van Dijk play am away.

90+5 mins: Last chance. Luis Diaz win corner.

E don finish.

Liverpool drop two points. Tottenham dey just one point off fourth.

EPL Table

Wia dis foto come from, BBC Sport

Similar news
News Archive
  • A Family Affair
    A Family Affair
    'A Family Affair' unites Nicole Kidman and Zac Efron in a slim idea ...
    28 Jun 2024
    2
  • NASDAQTLRY
    NASDAQ:TLRY
    Tilray's 40% Surge This Week: Is It a Good Buy Now?
    17 Jun 2024
    13
  • Rugby union
    Rugby union
    Maddison Levi takes out Women's Sevens Player of the Year at World Rugby Awards
    26 Nov 2024
    106
  • Anzac day 2022 nz
    Anzac day 2022 nz
    Governor-General's ANZAC Day Dawn Address At Pukeahu News
    24 Apr 2022
    1
  • CourierPost
    Courier-Post
    Mount Holly man accused of fleeing fatal accident in October 2020
    10 Jan 2022
    2
This week's most popular news